You and Your Kidney

You are welcome to the resource center wey we open for kidney health. Na for drivers o!

Wetin I Wan Teach You

Wetin I want make you sabi

Wetin kidney dey do for bodi

Types of kidney wahala

Wetin fit spoil kidney

How e dey affect kidney

Signs wey dey wen kidney don weak

How to prevent kidney wahala

How dem dey treat am

Suffering wey fit happen (complications)

Take-home message

Make people sabi wetin dey cause kidney disease, how dem de treat and prevent am. Main people wey we dey focus on na Commercial Drivers.

The purpose of dis talk-talk

Make you understand the meaning of kidney wahala

Make you know de main things wey dey cause kidney wahala

Make you sabi de kind signs and symptoms of the person wey get am

Make you know how to prevent kidney disease

Make you know how dem dey treat am

Introduction

  1. More than 500 million people for the whole world (about 1 pesin out of 10 adults) get one kind of kidney problem.
  2. Many people no know about kidney disease or say how important kidney dey for their bodi. Some even dey abuse am with the type of life dem dey live.
  3. If kidney spoil, e fit cause big sickness or even early death for some people.
  4. Kidney na very important organ inside pesin bodi.
  5. The 2 kidneys dey collect about 20 – 25% of blood wey heart pump inside bodi.
  6. Kidneys wey better dey filter dirty and plenty water comot for blood.

Hear am for audio

Common Kidney Problem

Di common kidney wahala wey dey happen for commercial drivers na:

Sickness dem like high blood pressure and diabetes, wey fit show because of stress and di kind lifestyle wey person dey live; Kidney stone, wey mostly happen when person no dey chop well or no dey drink enough water; Infection wey fit come from holding urine for too long; and acute and chronic kidney disease, wey fit happen if kidney get sudden injury or if di kidney dey spoil small small over time.

Click here to hear am for Audio

Wetin Pesin Go See for im Bodi if Kidney Spoil

  1. Plenty dirty go full inside de blood (uremia).
  2. Pesin bodi go dey swell (face, leg and hand).
  3. Im go dey pass small-small urine.
  4. Pesin go dey vomit or mind go dey do am like sai im wan vomit.
  5. The blood pressure go dey high.
  6. Blood go low for bodi bicos de kidney no fit produce enough blood.
  7. Confusion with headache go dey and sometimes convulsion.
  8. Person go dey always tire.

Click here to hear am for Audio

Wetin kidney dey do for bodi

  1. Remove plenty water and dirty from bodi.
  2. Help dey control blood pressure.
  3. Help dey produce blood for bodi.
  4. Keep bone strong kakaraka.
  5. Dey help balance chemical and hormone for blood.

Click here to hear am for Audio

Why Kidney Health Dey Important for Commercial Drivers’ Safety

Why kidney health dey important for commercial drivers’ safety?

Kidney wahala fit affect commercial drivers’ health and their safety well-well.

When kidney begin get problem, e fit damage the nephrons, wey be the part of the kidney wey dey do the main work.

If these nephrons spoil, e fit cause temporary or permanent kidney failure, and na serious condition wey fit endanger person life.

E go also affect how dem fit work because treatment dey cost money and fit reduce their productivity.

Click here to hear am for Audio

Work–Related Risk Factors for Commercial Drivers and How dem Fit Show

Di work risk factors wey dey affect Commercial Drivers and how dem fit take show dey below:

Sedentary Lifestyle
Because dem dey sit down for long hours and no dey do plenty physical activity, e dey put dem for high risk to get high blood pressure.

Dehydration
Dis one dey happen because dem no dey drink enough water so dem no go dey stop for toilet, plus heat inside motor dey make dem lose more body water.

Unhealthy Eating Habits
Dem eating pattern no dey stable, and many of dem dey chop food wey get too much salt, energy, and caffeinated drinks.

Stress and Irregular Sleep
Driving dey cause stress, and some drivers no dey get better sleep routine. Money wahala dey join, and all dis one dey affect their health.

Environmental Exposure
Dem dey exposed to motor fumes, dust, and small-small particles wey fit affect body.

Barriers to Healthcare
Plenty commercial drivers dey do self-medication with over-the-counter drugs to manage pain. Dem no dey go for regular check-up, and dem dey delay treatment when sickness start.

Click here to hear am for Audio

How to prevent kidney problem

  1. Check your bodi always for hospital.
  2. Make you go hospital early if you notice any problem.
  3. Drink water well, well.
  4. Reduce salt for your food as you dey grow for age.
  5. Stop smoking.
  6. Stop drinking too much alcohol.
  7. No dey take drug anyhow wey doctor no write for you or agbo/herbal medicines.
  8. Make you stop using bleaching cream or soap wey contain mercury If you dey use am.
  9. Control high blood pressure and sugar for your blood, and also do regular checkups.
  10. Make you dey do exercise always and no allow weight too much.
  11. Make you seek for correct information from medical people (doctor or nurse).
  12. Ask question wen you no understand sometins.

Click here to hear am for Audio

Treatment

  1. Best tin na to prevent am bicos wen kidney spoil, e no dey return to normal and e dey very expensive to treat.
  2. Early presentation for hospital fit help arrest de damage.
  3. Most kidney disease no get permanent cure; we just de slow down de damage make im no paafuka quickly.
  4. Wetin serious pass bi say many people no dey know on time wen their kidney get problem bicos dem still dey work.
  5. If kidneys spoil finish, dialysis or transplant na im de pesin go need to enjoy life.

Types of treatment wey dey

  1. Conservative – Pesin go dey use drug or eat special food to treat am.
  2. Dialysis – Dem fit use pesin bodi (peritoneal dialysis) or machine (hemodialysis) to dey wash the blood 3 times every week.
  3. Kidney transplant – Pesin fit donate kidney give de pesin.

Click here to hear am for Audio

Impact of Kidney Problem on Commercial Drivers

Kidney problem fit destroy the nephrons, wey be the main working parts of the kidney. When dis nephrons spoil, e fit cause temporary or permanent kidney failure. Because dis sickness fit threaten pesin life, people dey spend plenty time and money to reduce the symptoms, improve quality of life, and help the person live longer.

For the early stage of the sickness, drivers fit still do their normal activities of daily living (ADLs), because the sickness never really affect their driving work. But as the condition dey worsen, dem fit need medical report, change work, or even start dialysis to stay alive.

Click here to hear am for Audio

De End of the Talk-Talk

Kidney dey very important for pesin well-being. De pesin wey wan live long and enjoy life must try make im protect am. Everybodi suppose live healthy life and make im dey do regular bodi checkup.

Click here to hear am for Audio

Take-home Message

  1. Know say kidneys dey very important well-well for bodi.
  2. Make you love your kidney and value am well-well.
  3. Make you dey drink plenty water always and make you no hold urine for long time.
  4. Make you reduce salt for your food.
  5. No smoke / No drink local concoction / No drink alcohol too much.
  6. Go hospital check body.

Click here to hear am for Audio

Driver Suppose Follow These Daily Health Routines to Maintain Better Health

Drink at least 3 liters of water every day (about 6 pure-water sachets) to keep body hydrated.

Chop better, healthy food and snacks wey no get too much salt.

Use only the medicine wey doctor prescribe for you.

No hold urine for more than 2–3 hours, and observe any change for how you dey urinate.

Stay active by doing regular brisk walking.

Check your blood pressure and watch whether your feet or ankle dey swell.

Sleep well make your body fit rest.

Protect your kidney, you no fit get am for market!

Want to Talk?

Common kidney problem

Wetin pesin go see for im bodi if kidney spoil

Wetin kidney dey do for bodi

Why kidney health dey important for commercial drivers’ safety.

Work–related risk factors for commercial drivers and how dem fit show

How to prevent kidney problem

Treatment

Impact of kidney problem on commercial drivers

The end of the talk-talk

Take-home message

Àwọn àrùn tí ó wọpọ̀ lárin àwọn awakọ̀ ọkọ ero

Ipa lori awako

Àwọn nǹkan tí ó lèwu níbi iṣẹ́

Pataki ìlera kidinrin sí ààbò àwọn awakọ̀ ọkọ ero

Ìtọju

Ìkìlọ̀ tó yẹ ká gbé pẹ̀lú

Àmì àìsàn

Ìdènà

Ìṣẹ́ pàtàkì kídínrìn

Ìparí

Introduction

Introduction